Eye don clear?

Where Eagles dare! Discuss Nigerian related football (soccer) topics here.

Moderators: Moderator Team, phpBB2 - Administrators

Post Reply
User avatar
Sampo
Egg
Egg
Posts: 1903
Joined: Mon Dec 22, 2003 5:33 pm
Location: Christmas Island
Eye don clear?

Post by Sampo »

Those of una wey start family fights yesterday, una see now?

When people begin yab left and right- some come dey predict failure for Super Eagles :( As we don lose finish, every one eyes don clear now - make everyone go lick him wounds.

Oya cybereagles party don finish.. make all of una go take care of una mortgages, get a date, enrol for courses or do anything else with life jare. The next big thing wey dey come for Eagles na Olympic and WC qualifiers. Make una all come back then. Ah..make I no forget, the top pundits wey boku for here fit force dem way to the Board for Glass House, make we no dey let NASA-grade ideas on Naija footy be oly awoof for Cyberspace.

CAF go gree us walk away for the match against Mali so? Me I don tire for all this so so meaningless 3rd place wey plenty for SE credentials, so make we kuku dash dem Mali for the spirit of ECOWAS brotherhood. He don tay since that country get any medal. Plus including say plenty 3rd place no too good for our psyche o. He go come be like say we no get ambition again - small time dem Ghana-must-go plus Karate Lions eastern neighbours go flood here begin dey tease us say we no dey dem rank. One thing wey me I want be say our third and fourth ACN victories go happen before dem Cameroon fit smell ACN trophy again.

Tension climax finish - make everyone relax! Future dey look bright with all dem young guns wey go join this set wey try for Super Eagles well well. Abi una go say dem no show fighting spirit? None of una fit say this set dem be tired legs also.

Man don talk finish.
S a m p o
Fly, Eagles! Fly!!!

Post Reply